Thursday, March 28, 2013

RVP wan be Devil for life



Robin van Persie fil say in go stay kampe for Manchester United till in go retire afta the guyman bin enjoy insef for in fes seasin for Old Trafford. The ogbonge strika don jab korrect 19 Premier Lig gols since in waka lif Arsenal for August, and the Holland playa don dey lid United to cari dia numba 20 cup for England lig.

"I go dey here tey oh!" the 29 years playa bin yarn BBC for Wednesday. "United fit b my las klub."

Van Persie, dey like the new parade wey dey in front afta in spend eight years for Arsenal and in win the 2005 FA Cup wit the Gunnas.

E come be like say the way manaja Alex Ferguson dey trit all the paale wey dey dia team na im make van Persie like the parade for Old Trafford, Ryan Giggs b 39 years, Scholes sef don nak 38 years and dem still dey tap wella.

"Som klubs dey for Europe wey b say ol playas dey fil demself, where dem dey play, relax, e bin dey Juventus and AC Milan befor, but now Manchester United dey do the same tin. So, anyhow whichway I fit dey here tey." in tok

"I dey enjoy wetin dey here, my new new teammates dem, everibodi wit in own, e dey good for me sef, e go helep me tap ball wel wel."

Ferguson insef na guyman, Van Persie sef dey see say the 71 years manaja sabi laff.

"The ol paale na funi padi oh, Na one of the most funny pesin wey I don jam for my life. In get as in b if match dey, In sabi fight, just like playas sef," Van Persie add join.

"Holland coachi Louis van Gaal b like dat. Pipu no too undastan the man, wetin u see for TV no b the koko. Dat na jus like 20 pacent, e dey okay to judge, but if u wan juje, u go nid korrect infomashun.

Culled from: Supersport

No comments:

Post a Comment

Add A Comment

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...

ShareThis